Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Bikos wetin wi dey prish nor bi with mistake, dirty mind or wayo,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 2:3
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”


Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”


So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus,


Bikos dem bi fake apostles; pipol wey dey lie and pritend like sey dem bi Jesus Christ apostles.


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.


Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.


for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.


Make una allow di gospel enter una heart bikos wi nor do bad to anybody or fall anybody business or play anybody wayo.


As unasef know, wi dey trit una as papa dey trit en shidren.


Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.


So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie.


Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.


Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ