If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!
Bikos wetin wi dey tish una naw, na wetin Christ tish sey: Wi wey dey alive wen Jesus go kom, nor go follow am go kon leave doz wey don die bikos, all of us go-go with am.
My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
Dem go sey, “I tink sey Jesus promise sey E go kom back? Awa grand-grand papa dem don die since, but evritin still bi as dem bi since God kreate di world.”
(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)