Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 2:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 My brodas and sistas, afta wi leave una (even doh wi still dey tink about una), wi kon dey try to make sure sey wi si una again bikos of di love wey wi get for una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 2:17
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”


Den Israel sey, “E don do! My pikin Josef still dey alive! I go-go si am before I die.”


Israel tell Josef, “I nor bilive sey I go si yu again, but naw, God don let mi even si yor shidren too.”


But wen di king don forget about Amnon deat, e kon dey hongry to si Absalom again.


Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.


Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.


If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison.


Jesus tell dem, “I really won chop dis Passova food with una before I go sofa.


At wons, di brodas send Paul and Silas go Berea for nite. Wen dem don rish der, dem kon go di Jew sinagog.


My brodas and sistas, I wont make una know sey I don plan to kom visit una many times, but God nor let mi kom until naw. Bikos I won gain from una faith as I don do with Gentile pipol.


But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.


I know sey I nor dey der with una naw, but I dey with una for spirit. And I don already judge di pesin, just as I go do if I dey der.


And even if I nor dey der with una, my spirit dey der and I dey happy sey una mind nor dey shange and una faith for Christ, still strong well-well.


But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ