2 Wen ever wi dey pray, wi dey always tank God for all of una.
But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.
I dey always tank God, bikos of di grace wey E give una thru Jesus Christ.
Wi dey always tank God wey bi Jesus Christ Papa, anytime wen wi dey pray for una,
Wi still dey tank God evritime, bikos wen una asept God message wey una hear from us, una nor asept am like sey na human being message, but una asept am as God message and true-true na God message e bi and God dey work inside una wey don bilive.
and wi dey tank God for una. Wi dey tank am for di joy wey wi get for en present bikos of una.
Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.
Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,