E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.
Den Samuel take Saul and en savant enter room kon show dem where dem go sleep. Di place betta pass di ones wey dem give doz wey dem invite. Na like thirty men kom di sakrifice.
So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.