Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 9:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 “For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 9:16
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”


“Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.


My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!


But God still sorry for dem wen dem dey trobol kon listin to dia kry for help.


Make Yu feel my pains kon si my trobol, den Yu go forgive mi all my sins.


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


So, Hanamel kom meet mi for di kourtyard sey make I buy en field, just as God tok. Den, I kon know sey, God really tok to mi.


Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.


Den en and en men kon mash dey go fight Filistia pipol wey don dey fear and kill each oda with swod.


So God kon save Israel pipol dat day and di fight kontinue go rish Bet-Aven.


Den, Samuel kon tell Saul, “Na mi God send make e make yu king ova en pipol, Israel. Naw make yu listin to wetin God dey tok.


God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”


Den invite Jesse kom di sakrifice and I go show yu wetin yu go do. Yu go anoint di pesin wey I go choose.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ