Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 6:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 6:5
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make evribody praiz God! Make una praiz God for en glory and how E big rish.


Make una give God di praiz wey bi en own! Make una bring ofrin kom en present! Make una dey holy kon woship God!


Wons dem hear about mi, dem dey obey. Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi.


Both day and nite, God just dey ponish mi. My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.


But abeg, make Yu nor flog mi again! I don taya for di beat wey Yu dey beat mi.


Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa!


Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.


So Aaron nak di san with en stik and san-san fly kon full evriwhere for Egypt.


God do as E tok and fly wey dem nor fit kount kon full Fero, en savants and Egypt pipol house and many tins spoil, bikos of di fly dem.


God tell Moses, “Go tell Aaron, ‘Take di stik wey dey yor hand take face di river, creek and di ponds and frog go full evriwhere for Egypt.’ ”


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


Make di pipol wey dey stay far, give God praiz and glory kon tok as E good rish!


Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.


But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.” Mi, wey bi God, don tok.


Evry of una tin wey lokusts chop and distroy for doz years, I go give dem back to una, bikos na mi send doz lokust against una.


May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”


Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.


Naw, Egypt pipol beri all dia first-born pikin wey God kill and God still ponish dia juju.


So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”


So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”


For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.


Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”


den di heat kon dey burn pipol, yet dem still dey curse God wey get pawa to stop dis sofa and dem nor gri turn from sin kom meet God or gi-am all di glory.


So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well.


But afta dem don komot am, God attack di town again kon make all of dem dey fear. E make sore full di pipol body.


Den make una take di Kovenant Box put for di truck kon add di gold tins wey una won give God join am, as ofrin for wetin una don do so. Den una go send am go.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ