E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah.
Den di melu kon go strait to Bet-Shemesh. Dem dey make nois as dem dey go. Dem nor turn face left or rite. Filistia pipol leaders follow dem for back until dem rish Bet-Shemesh borda.
Di truck enter one field for Bet-Shemesh and na Joshua own, den e stop for der near one big stone. Di pipol skata di truck, kill and offa di two melu as burnt ofrin give God.