1 Samuel 5:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 So dem karry di box go Ekron, den di pipol for Ekron kon shaut dey sey, “Dem don bring Israel God Kovenant Box kom here, so dat e go kill awa pipol!”
I dey follow yu go anywhere wey yu dey go and I dey make yu win all yor enemies as yu dey fight. I go make evribody know yu for evriwhere, just as dem know all di big leaders for di world.
For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”
Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land
Den di men for Israel and Judah kon bigin sing war song. Dem porshu Filistia pipol go rish di valley and Ekron gate. Di Filistia man dead body dey groun for Shaaraim road wey dem dey pass go Gat and Ekron.
So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well.