22 E kon sey, “God glory don komot from Israel, bikos Filistia pipol don karry God Kovenant Box go.”
Dem kill dia priests and wimen wey dia husband don die, nor fit mourn for dem.
God disgrace Zion bikos E dey vex. E don trowey Israel pride from heaven kom down and E nor protet di temple again bikos E really dey vex with dem.
Den en disciples kon remember as den rite for Psalms Book sey, “Di love wey e get for en Papa house dey burn for en heart like fire.”
“ ‘Wen yor two boys, Hofni and Finehas, go die for di same day, den yu go know sey evritin wey I tok, go happen.
For dat day, I go ponish Eli family as I don tell am before and evritin wey I tok from biginnin go rish end, go happen!
E koll di pikin Ikabod, wey mean “God glory don komot from Israel,” e dey tok about di Kovenant Box wey Filistia pipol don karry go, en husband and husband papa wey don die.
Naw, Filistia pipol don karry God Kovenant Box from Ebeneza go Ashdod.