Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.
En pikin, Finehas wife get belle and don nearly born. Wen e hear sey Filistia pipol don take di Kovenant Box and en husband and en husband papa don die, e shaut well-well kon born. But di pains too mush for am.