E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die.
So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef.