2 Dem katch di wimen wey dey der, from di small ones go rish di old ones, but dem nor kill anybody. Dem just karry dem follow body.
I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der! Na here yor pawaful wave go for stop.’
True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
David kill both man and woman, so dat nobody go-go ripot dem for Gat. Dis na wetin David do all di time wen e dey Filistia.
Nor-tin lost, weda na small or big tin. E save pipol sons and dotas; di tins wey Amalek pipol take from dem and evry oda tin wey dem take before. David bring evritin kom back.
Wen David and en men rish di town, dem kon si sey Amalek pipol don burn am kon karry dia wimen, sons and dotas go.