Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 30:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 So di man take David go where Amalek pipol dey and David kon si sey dem full di land. Dem dey chop and drink; dey enjoy diasef, bikos of evritin wey dem karry from Filistia pipol and Judah land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 30:16
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon tell en savants, “Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di orda, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!”


where dem for kill Amalek pipol wey run go stay der and dem dey stay der kon rish today.


wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.


Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.


Di pipol wake-up di next day to offa burnt and peace ofrin. Afta dis, dem celebrate kon dey chop and drink, den dem start to do wetin God sey make dem nor do.


But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”


Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


kon sey, “Make una take dis tin dey go and dem bi plenty money, many-many animals, silva, gold, bronze, iron and many klot. Di tins wey wi karry from awa enemies, make una divide am among unasef.”


Gideon pass di road wey dey di desert korna for di east side for Nobah and Jogbehah kon go attack di sojas for der.


Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”


David kon tell am, “Yu fit take us go where yor pipol dey?” Di man ansa, “Make yu swear first sey yu nor go kill mi or give mi to my oga, den I go take una go der.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ