Some from Manasseh tribe still go meet David wen e follow Filistia pipol go fight Saul. (But, e nor help di Filistia pipol, bikos dia king dey fear sey e go sell dem give Saul wey bi en oga before, so dem send David and en men go back to Ziklag.)
Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem.
from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land
Dem kon ask, “Na wetin bi di ofrin wey wi go karry follow am?” Di priest and doz wey dey si vishon kon ansa, “Una leaders na five. So make una karry five gold sore and five gold rat, bikos na di same sickness do una with una leaders.