Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 29:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Filistia pipol gada dia sojas for Afek, while Israel pipol kamp for Jezrel wotaside.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 29:1
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na for der Abner for make Ish-Boshet king for Gilead, Asher, Jezrel, Efraim, Benjamin and all Israel aria.


Dem tell Filistia pipol sey dem don make David king for Israel, so dia sojas kon ready to go fight am. Wen David hear am, e kon go di aria wey dey save.


Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.


E get one vineyard wey dey near King Ahab palis for Jezrel and na Nabot get am.


“And for Jezebel yor wife, God sey, ‘Na dogs go chop en body for Jezrel town.’


Jehu kon ride dey go Jezrel. Wen Jezebel hear wetin happen, e paint en eye, do en hair well kon dey look from di window.


Dem kon go back go tell Jehu wetin happen, den e sey, “All wetin God tok thru en savant Elijah wey kom from Tishbe, don really happen. Bikos Elijah warn dem sey, ‘Na for Jezrel land, dogs go for chop Jezebel flesh kon lick en blood.


Gebal, Ammon and Amalek pipol with doz from Filistia and Tyre.


Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”


Umah, Afek and Rehob. Dem get twenty-two big and small towns.


Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley.


One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill.


E gi-am to Saul and en savants and dem kon chop. Den dem go back, dat same nite.


Filistia pipol gada kon kamp for Shunem. Saul gada all en sojas for Israel kon kamp for Gilboa.


Den Samuel tell Israel pipol wetin God tok. Israel pipol kon go fight Filistia pipol. Dem kamp for Ebeneza and Filistia pipol kamp for Afek.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ