One day, Elisha go Shunem, where one woman wey get money dey stay. Di woman kon sey make Elisha kom chop for en house, so wen ever Profet Elisha dey go Shunem, e go stop chop for der.
Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.”
Na white and blue curtain wey dem tie with fine purpol linen with silva ring and betta stones, dem take dekorate di kourtyard. Dem put tins wey dem make with gold and silva, for di kourtyard groun wey dem design with white, red, blue and black stones.
Afta en and en family don baptize, e kon beg us sey, “If una don asept mi as pesin wey bilive Christ, make una kon stay for my house.” So e beg us until wi gri.