19 God go give yu and Israel pipol to Filistia pipol. Tumoro, both yu and yor sons go dey with mi. God go still give Israel sojas to Filistia pipol.”
God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’ “Di angels kon dey tok difren tins,
Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una hear wetin I tok so o-o!”
Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil and evribody wey dey der, dey rest.
So, by dis time tumoro, I go make strong ice-blok rain wey dem dey koll ‘hail’, fall as e neva fall for Egypt before.
Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen.
But if una kontinue to dey do bad tins, God go distroy both una and una king.”
Saul kon kwik-kwik sleep for groun for der and e kon dey fear, bikos of wetin Samuel tok. E nor get any pawa to waka again, bikos e nor chop anytin from morning go rish nite.