Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 27:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dat day, Akish kon give David, Ziklag town. (Bikos of dat, na Judah kings get Ziklag kom rish today.)

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 27:6
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta Saul don die, wen David dey kom back from where e go fight and win Amalek pipol, e kon go stay Ziklag for two days.


Dis na di men wey join David for Ziklag for di time wey e dey run from Saul wey bi Kish pikin and dis men dey among di sojas wey help am for war.


Wen David go Ziklag, Manasseh men wey join am na: Adnah, Jozabad, Jediael, Mikael, Jozabad, Elihu and Zilletai and na one-one tazon sojas dem dey lead.


E risk en life wen e fight and kill Filistia pipol. God win big viktory for Israel pipol. Wen yu si and hear am, yu yorsef kon dey happy. So wetin go make yu won sin against pesin wey nor do any bad tin? Wetin go make yu won kill David yor savant for no rizin?”


David tell Akish, “If yu know sey I bi yor friend, make yu give mi one small town make I stay. Wetin go make yor savant dey follow yu stay di royal town?”


But Filistia pipol kommander kon dey vex with King Akish, den di oga sey, “Tell dem make dem dey go! Make David and en men go back to di place wey yu gi-am. Nor let am follow us go fight, bikos e fit turn against us for di fight. Wetin e go do take win en oga favor back, dan make e turn kon bigin kill awa own men?


For di third day, David and en men kon rish Ziklag. But Amalek pipol attack Negev and Ziklag. Dem burn Ziklag rish groun.


Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ