Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”
Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.
Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.
Afta some time, Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. So Akish kon tell David, “Hope yu know sey yu and yor men go follow mi go fight.”