Afta two years don pass, wen Absalom won kut hair komot from en sheep body for Baal-Hazor, wey dey near Efraim town, e kon invite all di king sons kom der.
Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars,
Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
Naw, David dey tink for en mind sey, “As I guide evritin wey bi dis man own for desert rish, so e nor mean anytin to am? I nor take anytin from am. But e don use wikedness take pay di good wey I do for am.