Di man kon tell Josef brodas sey, “Make una nor fear, evritin dey okay. Una God and una papa God don give una gift for una sak. Na mi put di money.” Den e bring Simeon kom out from prison.
Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.
Afta David don give wetin e karry kom to di pesin wey dey divide tins give di sojas, e kon run go di war front. Wen e rish der, e kon ask en brodas, how una dey?