40 So David savant go meet Abigail for Karmel kon tell am, “Na David send us kom bring yu as en wife.”
Na Rebekah stand so for yor front. Make yu take am dey go, so dat e go bi yor oga Abraham pikin wife, just as God don tok am.”
Dem dey respet woman wey dey respet pipol, but even with all di propaty wey wiked men get, nobody dey respet dem.
Wen David hear sey Nabal don die, e kon sey, “Make wi praiz God wey don fight for us, bikos of wetin Nabal do. God stop en savant to do bad and E don reward Nabal with di wiked wey e do.” Den David send pipol go meet Abigail sey make e bi en wife.
Abigail stand up, bow face groun kon sey, “Yor woman savant wey dey alone, go wosh my oga savants leg.”