So, abeg, make yu take all dis present wey I bring kon give yu, bikos God dey good to mi and I get evritin wey I wont.” Wen Jakob beg am well-well, e kon take dem.
David ask am, “Wetin yu won use all dis tin do?” Ziba ansa, “Di donkey na for my king, David family, di bread and di fruit na for di men to chop and na di wine dem go drink wen dem don taya for di wildaness.”
Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
Naim make mi beg dis brodas make dem go for my front before di time go rish and make dem help una arrange di money wey una promise, so dat una go do am with una mind and nobody go force una.
Wen David go back to Ziklag, e kon send some of di tins wey dem karry, go give di leaders for Judah wey bi en friends sey, “Dis gift na for una, wi take dem from God enemies.”