1 Samuel 25:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
25 My oga, make yu nor listin to dat wiked Nabal. E dey bihave like en name! En name mean ‘Fool’ and e really bi fool. But mi yor savant nor si di men wey yu send kom.
So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.
Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”
Abigail fall for groun kon sey, “My oga, I gri sey wi dey wrong. But abeg make yu let yor woman savant follow yu tok. Make yu listin to wetin yor savant get to tok.
“Naw my oga, as long as God dey alive and as long as yu dey alive too, God nor go let yu kill or do tins di way yu wont am. Naw, make yor enemies and doz wey dey try to wound yu, bi like Nabal.
Di man name na Nabal and en wife na Abigail. Di woman get sense and e fine well-well, but di man bad and na wiked tins e dey do. Na Kaleb tribe e from kom.