16 Both for nite and day time, dem dey guide us wen wi dey guide awa sheep.
Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals.
So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.
Bikos of dem, I go make yu bi like strong wall. Dem go fight yu, but dem nor go fit win. I dey with yu; I go protet and save yu.
God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”
Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”