Gad go meet and tell am wetin God tok, so e kon ask, “Wish one yu wont make God do? Three years wey honga go dey di land; three monts wey una go take run from una enemies or three days wey bad sickness go dey yor land? Naw, make yu tink am kon tell mi di ansa wey I go-go give God.”
Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.
Den David kommand en men, “Make una karry una swod,” and David karry en swod too. Like four hundred men kon follow David, while two hundred dey house with evritin wey dem get.