Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”
Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.
I go dey patient as God dey ponish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight for mi kon make mi win. God go take mi enter di lite and I go si en raitiousness.
Wen David hear sey Nabal don die, e kon sey, “Make wi praiz God wey don fight for us, bikos of wetin Nabal do. God stop en savant to do bad and E don reward Nabal with di wiked wey e do.” Den David send pipol go meet Abigail sey make e bi en wife.