Den Solomon tell Priest Abiatar, “Make yu dey go yor kountry for Anatot. Yu suppose to die, but I nor go kill yu naw, bikos na yu kare for di Kovenant Box wen yu dey with David my papa and yu follow am face all en trobols.”
Wen dem tell Saul sey David dey Keilah, Saul kon sey, “Today, God don put David for my hand, bikos e don put ensef for tight korna wen e enter town wey get only two gate and big-big iron.”