29 Den, David komot der kon go stay where strong pass for En-Gedi.
Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.
Some messenjas go tell Jehoshafat sey, “Plenty sojas dey attack yor town from di oda side for di Dead Sea for Edom side, for Hazezon Tamar wey bi En-Gedi.”
My love bi like Henna flower wey dey shine well-well for En-Gedi Field.
For En-Gedi go rish En-Eglaim wota, pipol dey go der go katch fish. Dem dey katch difren fish for der just as dem dey katch for Mediterranean Sea.
Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns.
So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot.
Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
David kon promise Saul. Den Saul kon go en house and David and en men kon go where dem go for dey save.