28 So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot.
Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free!
Saul and en men kon go look for David. But dem tell David, so e kon go stay di rock for Maon desert. Wen Saul hear sey e dey der, e kon porshu David go Maon desert.
But one pesin run kon tell Saul, “Make yu kwik-kwik kom, bikos Filistia pipol don dey skata di land!”
Den, David komot der kon go stay where strong pass for En-Gedi.
Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
So Saul take 3,000 men wey e selet from Israel kon go find David and en men for di aria wey rock dey for where goats for mountin dey stay.