19 Den Zif pipol go tell Saul for Gibeah sey, “David dey hide for Horesh near Hakilah Hill wey dey Jeshimon sout.”
If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins.
Wen Saul don porshu Filistia pipol kom back, dem kon tell am, “Si, David dey for En-Gedi desert.”
Zif pipol kom meet Saul for Gibeah sey, “David hide for Hakilah hill wey dey near Jeshimon.”
Saul kamp for di road wey dey near Hakilah hill near Jeshimon, but David dey inside di desert. Wen David know sey Saul dey di desert dey find am,