Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 23:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Wen di two of dem don make kovenant for God present, David stay for Horesh, but Jonatan kon go house back.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 23:18
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But bikos of di holy promise wey en and Jonatan don make give diasef, David nor kill Jonatan pikin wey dem dey koll Mefiboshet, wey bi Saul grand-pikin.


One day, David ask, “E get anybody wey remain for Saul family? If e dey, I go like do good for am, bikos of Jonatan.”


Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.


Jonatan kon make kovenant with David, bikos e love am as e love en own life.


Jonatan kon tell David, “Make yu go well, bikos di two of us don use God name take swear sey, ‘God go dey with mi and yu and even awa shidren-shidren forever.’ ” Den David get up kon run go, while Jonatan go back to di town.


Abeg, make yu do dis favor for mi, bikos yu don promise yor savant with God name. If I do wrong, na yu go kill mi my yorsef! Wetin go make yu take mi go meet yor papa?”


David go meet Ahimelek wey bi Nob priest. Ahimelek dey fear wen e meet David, so e kon tell am, “Wetin make only yu dey waka without bodyguard?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ