11 Di leaders for Keilah go put mi for en hand? Saul go kom as dem tell mi yor savant? My Oga wey bi Israel God, abeg make Yu tell mi.” Den God ansa, “E go kom.”
Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”
God give mi sense make I for fit undastand evritin, den E show mi wetin di pipol dey do.
“Koll mi wen yu dey pray and I go ansa yu; I go tell yu great and wonderful tins wey yu nor know about.
Den David sey, “My Oga wey bi Israel God, yor savant don hear sey Saul dey plan to kom distroy di town bikos of mi.
David kon ask, “Keilah leaders go give mi and my men to Saul?” God sey, “Dem go give una to am.”