war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.
So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”
Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.
So make yu go kill Amalek pipol. Yu go distroy evritin wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill evribody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.’ ”
Saul and en sojas nor kill king Agag and dem nor distroy di betta tins and animals. Dem nor kill all di animals, but dem kill and distroy di tins wey nor good for di town.