Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”
Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house!
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
Na today bi di first day wey I dey tok to God for am? E nor fit happen! Make di king nor blame en savant or evry priest for my papa house. Bikos yor savant nor know anytin wey dey happen at-all.”
Den di king tell di pipol wey dey with am sey, “Make una go kill God priests. Bikos dem don join David side. Dem know sey e dey run, but dem nor kom tell mi.” But di king savants nor gri tosh God priest.