4 Di priest ansa David, “I nor get ordinary bread, na only di holy bread dey and di sojas go fit chop am if dem nor sleep with woman.”
E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”
Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.
Afta di man don sleep with di woman finish, di man and di woman must go baf and dem go dey unklean till evening.
Den make dem still ask di priests and profets dis kweshon: “Make wi kontinue to mourn and fast for di fift mont just as wi dey do since?”
Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.
So naw wetin yu get? Make yu give mi five bread or anytin wey yu si.”
So di priest give David di holy bread, bikos no oda bread dey der. Dem take am from God present, so dat dem go put hot ones for der.