7 If yor papa kon sey, ‘No wahala,’ den make yu know sey I dey save. But if e vex, make yu know sey e won kill mi.
Absalom and all Israel leaders like di advise.
Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.
“I tink sey wetin una tok dey good, so I kon choose twelf men, one form each tribes.
Den Saul trow en spear face Jonatan, so dat e go pin am for groun. Den Jonatan kon know sey en papa won kill David.
Jonatan kon ansa, “Make yu nor even tink like dat! If to sey I know since sey my papa won kill yu, nor bi mi go first tell yu about am?”
Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”