But di next morning for di sekond day for di new moon, David seat still dey empty. So Saul kon tell en pikin Jonatan, “Wetin make Jesse pikin neva kom chop for dis tabol? E nor kom yestiday and e nor dey here today.”
E sey, ‘Abeg, make yu let mi go, bikos wi get family sakrifice for di town and my brodas sey make I dey der. So if yu bi my friend, make yu let mi go.’ Na dis make am nor dey di king tabol.”
If yor papa notis sey I nor dey di tabol, make yu tell am sey, ‘I beg yu make I go Betlehem, bikos di time wey di whole family dey sakrifice evry year, don rish.’