But bikos of di holy promise wey en and Jonatan don make give diasef, David nor kill Jonatan pikin wey dem dey koll Mefiboshet, wey bi Saul grand-pikin.
Jonatan kon tell David, “Make yu go well, bikos di two of us don use God name take swear sey, ‘God go dey with mi and yu and even awa shidren-shidren forever.’ ” Den David get up kon run go, while Jonatan go back to di town.