But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name.
So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave.
But di savant ansa, “Si, one God savant dey dis town wey evribody dey respet. Evritin wey e tok really dey happen. So make wi go der, may bi e fit tell us wetin wi go do.”