26 So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.
Potifa kon like Josef well-well as Josef dey serve am, so e make am oga ova all di savants for en house and evritin wey e get.
So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.
If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.
Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.
Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
Dem kon dey praiz God and dey fellowship with one anoda. So God kon dey add more pipol join dem evriday.
If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.
So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.
So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.
Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.