But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una.
So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us.
for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut.
Pipol don tok about Demetrius, bikos e dey do good and even di trut wey e know, show sey e good. Wisef dey tok about how e good and yu know sey wetin wi dey tok, na true.
But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.
Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.