21 So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.
God kon visit Sarah just as E sey E go do and E kon do wetin E promise Sarah.
Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.
If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.
“Make wi praiz Israel God, bikos E don help and free en pipol.
Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.
Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.
So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.
Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.