8 War kon start again. So David kon go fight Filistia pipol. E win dem well-well and di remainin ones, run from am.
King Ahab enter di field, karry dia horse and dia shariot kon win Siria pipol.
Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear. Even if dem attack mi, I don go shek at-all.
David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.
Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.
Den Jonatan bring David kon meet Saul and di boy kon dey serve am as e dey do before.
Den one wiked spirit from God kon enter Saul again. E sidan for en house with en spear for en hand, while David dey play di jita.
So David and en men kon go Keilah go fight Filistia pipol. E karry dia animals kon kill dem well-well. Na so David take save Keilah pipol.