For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’
Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,
So Saul send men go katch David kom. Wen di men si some profet dey tok wetin go happen with Samuel as dia leaders, God Spirit kon enter dem and demsef kon dey tok like di profets.
Den Saul kon go Rama by ensef. Wen e rish di big well for Seku, e kon ask, “Where Samuel and David dey?” Dem ansa am, “Dem dey for Naiot wey dey Rama.”