Absalom ofisas kom di house kon ask di woman, “Where Ahimaaz and Jonatan?” Di woman ansa, “Dem don cross di river.” Di men look for dem, but dem nor si dem. So, dem go back to Jerusalem.
So Saul send men go katch David kom. Wen di men si some profet dey tok wetin go happen with Samuel as dia leaders, God Spirit kon enter dem and demsef kon dey tok like di profets.