Dem give di head to David for Hebron kon sey, “Ish-Boshet wey bi Saul pikin; yor enemy wey won kill yu, na en head bi dis. Today, God don allow di king revensh Saul and en shidren-shidren.”
Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”
So e kon tell David, “My papa dey try to kill yu. So make yu take kare as yu dey waka for morning and find somewhere go hide and make yu stay der alone.
David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”