Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 18:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So Saul kon dey look David one kind from dat day go.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 18:9
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.


Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’


to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom.


My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.


Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,


Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”


Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ