29 e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.
Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.
Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David.
Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am.
Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,
Anytin time Filistia oga karry dia sojas kon fight, David dey win dem pass any oda Saul savants. Bikos of dis, pipol kon know David well-well.